Alcohol Na Your Mate Lyrics by Skales Feat. Faze & Magnito

1 hour ago 1

Skales, Faze and Magnito Lyrics

With infectious lyrics and catchy melodies, Alcohol Na Your Mate by Skales, featuring Faze and Magnito is bound to uplift your spirits and make you move to the rhythm.

Cover art for Matinas Son Album by SkalesMartina's Son Album Cover Art

Skales, Faze & Magnito - Alcohol Na Your Mate Lyrics

Verse 1
I'm a lil psycho, bọ sagbo
Cause I don dey shine dem wan dim my glow
Cause I got the crown dem wan steal my throne
Tell them once again I’m back in my zone
I keep a lil circle all about my dough
Always do it big never ever micro
Got a couple women I dey steady bankroll
I do whatever's good for my soul, let's go

Pre-Chorus
Na the way I dey feel and the way I dey talk
When they pass me the bill I begin to the feel kolomental
Everything is detrimental
I just say make I chill With a bottle of drink
Now I'm buying more drinks wetin I been dey think kolomental
Now I'm feeling sentimental

Chorus
Oh my God I'm feeling sexy
Alcohol na your mate? (Alcohol na your mate?)
Alcohol na your mate? (Alcohol na your mate?)
Alcohol na your mate? (Alcohol na your mate?)
Take am easy no dey rush me
Alcohol na your mate? (Alcohol na your mate?)
Alcohol na your mate? (Alcohol na your mate?)
Alcohol na your mate? (Alcohol na your mate?)

Post-Chorus
Get down
Uhh-uhh
Get down
Uhh-uhh
Get down
Uhh-uhh
Get down

Verse 2
There's a difference between Aquafina and Sapẹlẹ
Before you take enough sip o make sure say your head fit to carry the helmet
Ọmọ na mental case o so watch your gauge o as you dey merriment
No go carry soldier babe say na highness na to your own detriment
More chicks wey go line up
Big things we dey ride on
More drinks let’s whine up
I wanna know what you getting high on
You never chop belleful you dey order bottle
Ṣhey Alcohol na your mate? (Alcohol na your mate?)
You never chop belleful you dey cancel bottle
Ṣhey Alcohol na your mate? (ṣhey alcohol na your mate?)

Chorus
Omg I'm feeling sexy
Alcohol na your mate?
Alcohol na your mate?
Alcohol na your mate?
Take am easy no dey rush me
Alcohol na your mate?
Alcohol na your mate?
Alcohol na your mate?

Post-Chorus
Get down
Uhh-uhh
Get down
Uhh-uhh
Get down
Uhh-uhh
Get down

Verse 4
Ṣẹpẹ and casamigos no dey the same class
Coke and Champagne no dey share the same glass
Goat and rabbit no dey eat the same grass
I be Dangote pikin you no dey see resemblance
You dey order drink and you no go pay for am o
She wan suya I don pay for ram o
E don dey tipsy I dey fear am o
Him house dey for near beach e dey stay Kuramo
Ai juice nake sha I just dey sha kapu sha kapu
Sai su bani su ce sha kapu sha kapu
Toh kar inzo infara takapu takapu
Na all the bill I just dey try calcu' try calcu'
Behavior go change if you mix all the drinks
If e come begin commit all the sins
If you tell make e stop make him leave all this things
E no go gree until him begin vomit for him jeans

Outro
Na the way I dey feel and the way I dey talk when they pass me the bill
I begin to the feel kolomental
Everything is detrimental
I just say make I chill with a bottle of drink
Now I'm buying more drinks wetin I been dey think kolomental
Now I'm feeling sentimental

Check Lyrics of latest songs here, and get fresh updates as they drop via X and Facebook

The post Alcohol Na Your Mate Lyrics by Skales Feat. Faze & Magnito appeared first on NotjustOk.

Read Entire Article
All trademarks and copyrights on this page are owned by their respective owners Copyright © 2024. Naijasurenews.com - All rights reserved - info@naijasurenews.com -FOR ADVERT -Whatsapp +234 9029467326 -Owned by Gimo Internet Tech.